247ariya Pidgin!! Army Dey Steal Nnamdi Kanu’s Properties – IPOB Don Accuse Army With CCTV Evidence

Indigenous People of Biafra, IPOB, wey dey seek for Referendum to get dia own country, Biafra, don accuse Nigerian Army, and Polic. say, dem dey loot and dey steal Nnamdi Kanu properties wey dey Afaraukwu, Ibeku Royal Kingdom, Abia State.

IPOB don make dis allegations for statement wey dia mouthpiece, Mr, Emma Powerful give, say Army and Police don dey loot Nnamdi Kanu’s properties for Eze Kanu’s palace with 15-Hilux Vans.

Powerful talk say,

“We, wey be Indigenous People of Biafra, IPOB, worldwide dey alert people for di raid wey Army dey do for Mazi Nnamdi Nnamdi Kanu’s house, wey dey Afaraukwu, Umuahia, as dem dey steal and dey loot di palace of Royal Majesty, Eze Israel Kanu for many weeks now”

“CCTV don record dem well, as dem no know say, we keep such thing for di house. Di murderous Nigerian Army enter di house with 15-Hilux Vans for second time with 24-hours and stay for five hours inside di house, and di compound, dey pack Nnamdi Kanu’s properties and him wife’s clothes and jewelleries and properties wey dia family get “

” After dem comot, dem come back, come dey find di CCTV camera but dem no see am. Na dis time wey dem accept say, dem dey raid di palace “

” We dey tell Countries wey dey Civilised, national human rights groups, and people wey get better conscience, to tell Nigerian Army to provide di properties wey dem collect from di palace “

Him come add for him talk say, make stop dey lie, and bring out Nnamdi Kanu wey dem arrest on 14th November, 2017.

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.