News

247ariya Pidgin!! Dss Dey Stop Journalists Make Dem No Cover Nnamdi Kanu’s Court Case


Department of State Services people , DSS, on Tuesday don stop journalists, and people wey dey report tori, make dem no cover di trial wey High Court dey do for Nnamdi Kanu matta.

 

DSS don gather for di court door, wey be Abuja Federal High Court room, as dem talk say, Federal government tell dem make dem no allow any media to cover di court case for di room.

One person for di DSS operatives, as him dey address journalists, for di entrance, talk say,

“We dey work under directives from Federal government “

Another operative wey wear plain cloth talk say ,

“We go allow you people to enter, wen di time reach”

Nnamdi Kanu court matta go dey under trial today, as we dey wait to bring to una wetin dey happen, wen dem go allow us.

IPOB leader, Nnamdi Kanu never show, and we never hear from am, since Army people enter im house for Afaraukwu, Ibeku Royal Kingdom, Abia State, on September, 14.

Di matta be say, e dey bad di way Nigerian government carry army go dey chase person wey still get questions to defend for court, as e show say, dia hand no dey clean for dis matta.

Make di World dey watch, and make you, wey dey read ditori dey watch too o.

Share On:

TAGS: , , ,



CLICK HERE TO PROMOTE YOUR MUSIC/VIDEO
  • Biafra: Nnamdi Kanu Defeats Federal Government in ECOWAS Court

  • How I Was Smuggled Out Of Nigeria During Operation Python Dance – Nnamdi Kanu

  • Lawyer To Sues Buhari & others N50bn over judges Arrest [See Full Story]

  • President Buhari Will Die – Igbo Prophet Reveals Shocking Prophecies

  • Nnamdi Kanu Is Bigger Than President Buhari – Fani Kayode Says



  • 0 Responses

    Leave a Reply

    Dark