247ariya Pidgin!! RRS Don Arrest 3 Robbers After Felabration For Lagos


Just for late Friday night and early Saturday morning, d Rapid Response Squad for d Lagos State Police Command don arrest three robbery suspects for separate kwanta for different parts of d state.

D suspects: Moshood Olowu (24) and Olasunkanmi Ogundipe (26) bin follow attend d “Felabration” with dia fellow robbers bin rob two people for Ojota and Ketu.

 

D RRS patrol team kon arrest d third suspect, wey be Rasak Adebola (22) after him snatch one Helen Susan handbag for Ikate.

For Moshood Olowu, him and two oda people, wey Police dey find now, bin comot for New African Shrine wey dey Alausa Business District, Ikeja, kon dey go Ikorodu through Ojota when dey committed d crime. Three of dem join head together to take commit d crime.

As him take talk am, him say;

We bin dey Ojota around 5:00 a.m. after we comot from “Felabration”, we kon enter bus wey dey go Ikorodu. I chook my hand inside another passenger pocket when we bin dey rush to enta bus. I comot him phone kom pass am give my colleagues dem, Ayobami and Jide.

D owner kon hold my hand wey stop me from entering d bus. Ayobami and Jide, wey I give d phone wey I thief to, kon run comot. Na so dem call RRS police wey kon arrest me’.

For d second group wey be say dem reach 9,

Olasunkanmi Olajide talk say,

I bin dey d company of eight other boys wey bin dey come from New African Shrine when we meet one Pastor Adetayo Samuel wey bin dey wait to enter bus to Ibadan around 5:00 a.m. for Old Toll Gate, Ketu. We collect him three mobile phones from am with N6, 000:00.

‘We run comot from d place immediately kon scatter ourselves into three groups. D man kon alert RRS patrol team and na so dem arrest me when I bin wan enter bus go Ibafo’.

According to d third suspect, Rasak Adebola, him yan say;

‘I bin dey go Ajah to go crash as I don tire. Just before I reach Chisco around Maroko for about 11:00 p.m., I snatch one lady bag. I bin wan escape but d RRS men just show for my front, I kon wait, kon give dem d bag.

I no know wetin come do me. I bin get only N200 for hand. I bin dey wait make traffic build up. I never enter prison before. Abeg make dem pity me. I no go ever try am again. Him follow talk say;

I bin dey ride okada for Shomolu. I just come Ajah to learn carpentry make I fit serious small’.

#confamtori

1 Comment

  1. Wow, superb blog layout! How long have you ever been blogging for?
    you made blogging look easy. The full look of your web site is fantastic, let alone the content material!
    You can see similar here dobry sklep

Leave a Reply

Your email address will not be published.