247ariya Pidgin!! Police Don Arrest Davido For Murder With CCTV Evidence


Lagos State Police Command don arrest Hip hop music artist, David Adeleke, wey people dey call DAVIDO based on say, him kill imm friend, Tagbo.

Person wey people no know, kon carry Tagbo body go drop for d front of Lagos Island General Hospital gate, run comot.

D matta don go everywhere as Tagbo former babe wey be actress, Caroline Danjuma, carry d matta go Instagram go write say, Davido don kill imm friend, Tagbo.

Since dat time, people don dey criticise Davido anyhow, based on say imm dey deny d matta wey concern im friends death, as dem don reach up to 5 people wey die.

As di tori dey, Divisional Police Officer, for Ikoyi, Lagos State don invite am, and ask am questions wey concern di matta on Wednesday .

D person wey be Lagos commissioner of Police, Imohimi Edgal, don confirm say, Police don arrest am, based on CCTV Evidence wey show say, na him and him friends carry di guy go drop for di hospital gate, run comot.

D tori carry am say, Police invite DAVIDO, based on di CCTV evidence wey dem get.

D matta be say, na Davido wey Police talk say him be d person wey dey kill im friends, as dem never know why im dey kill dem, but dem go still investigate d matta well well.

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.