247ariya Pidgin!! Buhari Go End For Defeat And Shame – Femi Fani Kayode


Former Minister of Aviation wey be Femi Fani-Kayode. . .(FFK) don comot kom talk sey Oga Presido Muhammadu Buhari administration, go end for defeat and shame and sey imm wickedness no go go unpunished.

 

FFK talk dis one for some of hin tweets yesterday night.

Him talk sey shey now no be Buhari sign d 648billion naira worth of oil contracts when imm bin dey for hin sick bed for London and sey na Osibanjo wey sign dem. Him talk sey na better lie, sey dia cabal no even trust Osibanjo with toilet paper talk less of to sign 648 billion naira contract.

Him sey one thing wey imm know be dis . . . sey Buhari na man-made President and sey no be God make am.

Him sey imm be like Saul for Bible…and sey d way Saul use end for defeat nd shame na d same way hin go end too and sey imm must pay for imm wickedness.

Him still talk sey d good news be sey as Saul come na so David come too, sey soon our own David go come.

#confamtori

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.